Donald Trump 'overdose' warning from Rolling Stones not to use dia songs, want BMI to pronounce stop witout permission

by 24USATVJune 28, 2020, 10:40 a.m. 65
-

Statement wey comot from di band lawyers say dem dey work wit di perfuming rights joinbodi, BMI to stop di use of dia music witout permission.
Di Trump campaign bin use di song 'You Can't Always Get What You Want' for last week rally for Tulsa, Oklahoma.
Dis na di same song wey Trump campaign bin use during di 2016 US election.
Dat time, di band tweet say, "Di Rolling Stones no support Donald Trump."
For di statement dem drop on Saturday, di group representatives for di group tok say dem dey take more steps to stop oga Trumo to dey use dia music for presidential campaigning on top say di "cease and desist" dem doon do before no work.
Tori be say di BMi don follow det warn di Trump campaign to stop to dey use dia music without permission say dem fit carr di campaing go court.
For April, di Rolling Stone, with dia leader 76 year old Sir Mick Jagger release dia first single in eight years wey dem call, Living In A Ghost Town.
No be only Rolling Stone dey vex for Trump campaign use of dem songs, earlier dis month, anoda rock start Tom petty family comot to give cease and desist letter to di campaign ova di use of im song I Won't Back Down for di Tulsa rally.
For statement wey dem post on Twitter, di family say di late artist "no go ever want make im song dey used for campaign of hate".
End of Twitter post, 1
Tom Petty die for 2017 at di age if 66 of accidental drug overdose from painkiller.
Campaigning go still dey go on for America as oga Trump dey face Democratic Party nominee Joe Biden for di November presidential election.
Di presido bin follow thousands of im supporters for Florida tok as dem begin hail "keep America great".
America president Donald Trump don start campaign to win another term for office for di 2020 election.
People around the world, including celebrities, don join in for the Don't Leave Me challenge.
N-Power na job creation and empowerment programme of Nigerian goment.for young pipo for di kontri.
Wit dis new arrangement, audience go fit to enjoy BBC News Minute anytime dem want, weda for night or day.
Damilola Adegbite and Beverly Naya tok about di challenge of being a single mother and cyber bullying.
Ex-footballer Chichi Igbo tok to BBC Pidgin about her experience with cyber bullying.
Ernest Boateng just born im second child but im no fit celebrate with im wife because she die from coronavirus.
Prince Larbie dey throw about 150 punches in 1 minute at very fast pace
Tinubu accept Buhari decision on All Progressives Congress APC crisis afta Oshiomhole exit.
Lagos state goment say di former Oyo state govnor, Senator Abiola Ajimobi die from multiple organs failure afta complications from Covid-19 infection.
Na Victor Giadom call for dis meeting and President Muhammadu Buhari dey also attend.
2020 BBC. De external site no concern BBC.

-

Related Articles

HOT TRENDS

Press Room: Jim Montgomery | Boston Bruins

by 24USATVApril 23, 2024, 9 p.m.2
HOT TRENDS

LIVE: Arsenal vs Chelsea – Premier League football

by 24USATVApril 23, 2024, 8 p.m.2
HOT TRENDS

Las Vegas Aces star Kelsey Plum, ex-Raider Darren Waller divorcing

by 24USATVApril 23, 2024, 8 p.m.2
HOT TRENDS

Ground Beef Recall Due to Possible E coli

by 24USATVApril 23, 2024, 3 p.m.2
HOT TRENDS

Watch the Full Pink Moon 2024 bloom in the night sky tonight

by 24USATVApril 23, 2024, 3 p.m.2
HOT TRENDS

Mutua Madrid Open Results

by 24USATVApril 23, 2024, 2:01 p.m.2